Friday, 24 August 2018

Conversation with mind

Conversion with my mind

Mind: Hey, there's no need asking how you're doing cos we both know you're just there

Me: hahaha well..man's not gonna kill himself😎

Mind: Shaa...ceejay how them babes be naa

Me: which babes😂 the 1 wey u dash me or what

Mind : bastard.. No go find babe..dey there  dey  Waka  up and down 😂

Me: no be say man no wan babe oo😅😅..jusy dat man dey crush  on his bestie

Mind: You be fool oo... Wait sef... Which of the besties cos 1 dey date already 😂

Me: the black fine 1 since 100lvl days Naah😁😁😁

mind : nawaoo... I be think say we don close that chapter since 🤔

Me: I been dey think d same thing.. But las Las man dey attached to her

Mind:  Oya go tell am say you like am

Me: Baba I no get mind tell am😓😓😓

Mind : shatap..how u go say u no get mind.. Wetin I be b4... Better man up and tell her u like am.  Since 2014 u go dey kill ur self on top her matter.  Even those wey dey do 4 yr program Don graduate and u still dey her matter. You tire me oo😒😒😒😒

Me:😂😂😂😂 baba you no go understand.. I dey fear say if I tell am now our friendship go scatter and na there it would  worsen

Mind: nawaa.. U dey fuck up I swear 😅 ...shaa d babe worth am.. But I go laugh u Las Las if you still dey hope on am and it no work.

ME : 😓😓😓 wetin man go come do..

Mind: shaa.. You go soon return.. September rush things on point 😎

Me: you and who.. Since I enter that schl I never do September rush... Na them dey rush  me😋😋😋

Mind: GTFO...proud bastard..u go graduate single if ur not careful..them guys go dey go block and u go marry ur laptop dey play game even if u be shadow

Me:😂😂😂😂 shaa anything is possible... If I no see wetin to do during blocking time man go play games or Las Las do Royal stroll

Mind: if I fit change body I for Don abandon u here long ago.. Useless somebody.. Shaa... Man's broke wetin we go do about it 🤔🤔🤔

Me: relax... School go soon resume money go show.. 😂😂

Mind: it's  well.... Sleep Don dey my eyes

Me: same here bro.. Sweet dreams 😘

Mind: nigga WTF... U gay?  Dahs y u are single 😂😂😂

Me:😂😂 FUCK u... Oya good night bro..

Mind: you too man🙌🙌

No comments:

Post a Comment