Conversion with my mind
Mind: Hey, there's no need asking how you're doing cos we both know you're just there
Me: hahaha well..man's not gonna kill himself😎
Mind: Shaa...ceejay how them babes be naa
Me: which babes😂 the 1 wey u dash me or what
Mind : bastard.. No go find babe..dey there dey Waka up and down 😂
Me: no be say man no wan babe oo😅😅..jusy dat man dey crush on his bestie
Mind: You be fool oo... Wait sef... Which of the besties cos 1 dey date already 😂
Me: the black fine 1 since 100lvl days Naah😁😁😁
mind : nawaoo... I be think say we don close that chapter since 🤔
Me: I been dey think d same thing.. But las Las man dey attached to her
Mind: Oya go tell am say you like am
Me: Baba I no get mind tell am😓😓😓
Mind : shatap..how u go say u no get mind.. Wetin I be b4... Better man up and tell her u like am. Since 2014 u go dey kill ur self on top her matter. Even those wey dey do 4 yr program Don graduate and u still dey her matter. You tire me oo😒😒😒😒
Me:😂😂😂😂 baba you no go understand.. I dey fear say if I tell am now our friendship go scatter and na there it would worsen
Mind: nawaa.. U dey fuck up I swear 😅 ...shaa d babe worth am.. But I go laugh u Las Las if you still dey hope on am and it no work.
ME : 😓😓😓 wetin man go come do..
Mind: shaa.. You go soon return.. September rush things on point 😎
Me: you and who.. Since I enter that schl I never do September rush... Na them dey rush me😋😋😋
Mind: GTFO...proud bastard..u go graduate single if ur not careful..them guys go dey go block and u go marry ur laptop dey play game even if u be shadow
Me:😂😂😂😂 shaa anything is possible... If I no see wetin to do during blocking time man go play games or Las Las do Royal stroll
Mind: if I fit change body I for Don abandon u here long ago.. Useless somebody.. Shaa... Man's broke wetin we go do about it 🤔🤔🤔
Me: relax... School go soon resume money go show.. 😂😂
Mind: it's well.... Sleep Don dey my eyes
Me: same here bro.. Sweet dreams 😘
Mind: nigga WTF... U gay? Dahs y u are single 😂😂😂
Me:😂😂 FUCK u... Oya good night bro..
Mind: you too man🙌🙌